Blood and Blessing

📖 Blood and Blessing By Emeka Kross Chapter 1: Di Man Wey Come With Coffin “No be all coffin mean death. Some dey carry legacy wey no fit die.” Ajangbadi sun no get mercy that afternoon. The heat choke like unforgiveness. Even breeze no get strength. Street quiet like graveyard, but e no be peace wey dey hold people mouth — na expectation. Something dey come. No, somebody dey come. Children stop ball. Women wey dey gossip for roadside suddenly hold wrapper tight. Agberos, normally noisy like generator, dey silent like dem see spirit. Shop owners quietly pull down their half-glass doors. Na the kind silence wey only coffin dey command. Then, the sound of tyre pressing gutter iron break the silence. A black Prado jeep enter the street slowly. E no blow horn. E no rush. E just drive like say e get license from ancestors. Two men in black native come down. Dem no talk. Dem no smile. One of them open the boot, and slowly like ritual dem bring out a coffin. Yes. Real coffin. Polished ...